Friday, 03 May 2024

CHRISTIANITY NOR BE STUPIDITY: If e dey waka, ground dey shake:

CHRISTIANITY NOR BE STUPIDITY

*** One Family for Sapele here for MTN Road, Okirigwhere embarked on 2 Months Dry Fasting and the wife die during the process***

A family of Husband, Wife, Son and Friend wey lock themselves for inside house for about 2 months, na today nai neighbours just dey discover say one of dem (the wife) don die. The pikin don lean like broom as e say na so so water dem dey drink for about 2 months now. The friend wey dey house with dem for since December say dem dey fast. This issue happen today for No 15, G-Class House, MTN Road, Okirigwhere, Sapele.

Dem don carry those wey survive go Warri as ambulance carry the dead body of the wife go Central Hospital for Warri.

Mainwhile, for the video wey we upload so, the lean woman wey dey waka go for the gate nai be the so called friend wey con follow the family stay and people dey suspect say na witch because neighbours say dem dey give dem food but she go troway am dey tell d boy make he nor eat. The lean boy wey he picture appear under this update so, he fat full ground before. If e dey waka, ground dey shake. Na this friend wey come follow dem stay so, nai initiate the dry fasting for this family wey take the life of the wife so.

Make dem investigate this matter well sha.

Weytin be unu reaction to this development?

 

 
See post below: 

 


Credit link:  

https://www.facebook.com/oghenek/posts/2652860878159001

 

 

 

News Letter

Subscribe our Email News Letter to get Instant Update at anytime

About Oases News

OASES News is a News Agency with the central idea of diseminating credible, evidence-based, impeccable news and activities without stripping all technicalities involved in news reporting.